Who tiff our Afrikan Cup o?

Who tiff our Afrikan Cup o?

Afrika, my Afrika
Una no go kee person sha
Wetin I dey hear so?
Dem say awa Cup don answer mississippi?

As in, the trophy loss go
Inside Cairo of Egypt
The cup just take waka
Just laidat?

Ehn, just laidat!
Say who die?
The cup don turn to children of Israel again?
Abeg if na joke make una stop am

Just gba break for dia
Bring back awa cup
before we do you strong thing

No try us dat thing wey oyibo do for England and Brazil o
Na so dem take tiff World Cup two times
Na him you Egyptians want do us gboju-gboju
For inside dis our Afrika

Da, make una no just vex us o
If we send thunder come that una Cairo
Una go produce awa Africa Cup of Nations back
E no mean say because una win am for keeps
Una go come lose am for keeps

We wee not take it
Make una no come shame Afrika laidat
Anyhow una want do am
Just bring out the cup
Nonsense and ingredient!๐Ÿ˜Ž

Written by
Obo Effanga
Join the discussion

Follow @obo.effanga

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Instagram

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .